Home Back

Who be French politician Marine Le Pen?

Informationng 3 days ago
Marine Le Pen for 2024

For France first round of parliamentary elections on 30 June, National Rally bin come through as di kontri most popular party – and e fit form di next goment if dem win di majority of seats for di National Assembly for di second round on 7 July.

Wen Marine Le Pen bin take over di leadership of di party from her papa 13 years ago, dem bin see am as “untouchable” group wey dey di extreme right.

However, she don work hard to soften dia image and make am electable.

Ms Le Pen bin tanda one side as National Rally leader wey favour Jordan Bardella – to become leader of im parliamentary group instead.

However, many see her as di architect of di modern party and im dominant personality.

Wetin make Marine Le Pen enta politics?

Marine siddon on her papa Jean-Marie (C) lap for 1974, wit her mama Pierrette for im right and her sisters on both side.
Marine siddon on her papa Jean-Marie (C) lap for 1974, wit her mama Pierrette for im right and her sisters on both side

Marine Le Pen bin get two traumatic events for her childhood wey helep to shape her as pesin and politician.

For 1976, wen she be eight years old, pesin bin set her family flat on fire for night.

She tok say na dat point she understand say her papa, Jean-Marie Le Pen, dey widely hated sake of e be founder of di far-right Front National, or National Front, party (FN).

For her autobiography, One contre flots (Against di Waves), she say school mate dey laff her and teachers criticize her sake of she be im daughter. She tok say e bin make her feel like outsider.

“One cordon sanitaire dey created around us,” she bin write. “No go near di Le Pens.”

Damage wey bomb attack do di Le Pens family flat for Paris for 1976
Dem bomb Marine Le Pen home for Paris wen she be eight years old

For 1984, her mama Pierrette bin leave home (call her husband di devil and pose semi-naked for Playboy magazine as act of revenge against am). Ms Le Pen tok say dis bin make her feel unloved.

Dis experiences mean say she bin develop tough outside.

“Afta everytin she bin go through for her youth, she build herself shell,” her friend and political colleague Steeve Briois bin tok.

Ms Le Pen bin qualify as lawyer for di early 1990s from one ogbonge university for Paris, but find say odas don boycott her for di profession sake of of her family name.

For 1998, she bin decide to work full time for di National Front as di chief lawyer, and she become dia deputy leader for 2003.

For 2004, she dey elected as Member of di European Parliament (MEP), one seat she go hold for 13 years, wey give her platform to express di party anti-European and anti-immigration views.

How Marine Le Pen change di National Front to National Rally?

Marine Le Pen wit her papa Jean-Marie, for one rally for 2015
Marine Le Pen bin try cleanse di party of di toxic image wey her papa (L) bin give am. She bin force am out for 2015

For di 2002 presidential elections, Jean-Marie Le Pen make am to di run-offs against incumbent President Jacques Chirac. Dat na im best performance since e find di FN for 1972.

Oga Chirac centre-right supporters unite wit voters on di left to keep Oga Le Pen out of power, and e take only 18% of di vote. E bin do worse for di 2007 presidential election, win only 10% of di vote.

Back den, most of di public bin see di FN as one party wey get stigma on di extreme right of politics.

Popularly, Oga Le Pen bin tok for 1997 say di Nazi gas chambers na “one detail for di history of World War Two”. Im opponents tok say dis prove say e dey antisemitic.

For 2011, Ms Le Pen take over di leadership of di National Front from her papa and begin try to clean up di party toxic image – one process wey dem sabi as de-demonisation.

Dem bin chase comot clear racists from di party, and she bin make efforts to befriend di Jewish community.

For 2015, Oga Le Pen repeat im notion say di gas chambers na”one detail” of history and her daughter bin suspend am from di party – later force am out.

She campaign for elections as “Marine” and avoid to use di family name.

For 2018, she soften di party image more as she change im name to National Rally, and she let dem know say she be cat lover (she own six of di creatures).

Marine Le Pen dey pet one of her cats
To project softer image, Ms Le Pen let voters know she be cat lover

Like di old FN, National Rally dey against mass immigration, di “Islamification” of French life and di global financial system. E also wan give French nationals priority over immigrants to get jobs, social housing, health care and benefits.

E wan scrap di automatic right to French citizenship for children wit foreign-born parents wey dem born for di kontri, and propose to ban di wearing of headscarves for public – wey dey seen as anti-Muslim policy.

However, di party don drop dia proposals to withdraw France from di European Union and Nato.

E wan scrap VAT (sales tax) on energy bills, and leave pipo of age under 30 from income tax.

French philosopher Bernard-Henri Lévy tok say e become “di far right wit human face”.

Marine Le Pen argue say about her headscarf ban wit one woman during di 2022 presidential campaign
Ms Le Pen don cause vex among France Muslims sake of her proposals for one headscarf ban

Ms Le Pen bin win one seat for France National Assembly for 2017, and stand down as MEP.

She now be di National Rally parliamentary leader, wey hand over di party leadership for 2021 to her protege, Jordan Bardella – one man wey dey im 20s wey bin grow up for di deprived outskirts of Paris.

How popular National Rally don become?

Marine Le Pen and Jordan Bardella for one party rally
Marine Le Pen protege Jordan Bardella now dey lead National Rally and aim to be France next prime minister

For di first parliamentary elections wey hold afta Ms Le Pen bin take over di party leadership, for 2012, National Rally bin gbab 3.5 million votes for di first round, and win only two seats.

For di 2022 elections, e win 4.2 million votes for di irst round and win 89 seats for parliament.

However, for di European elections for June 2024, National Rally come through as France most popular party, tak 31% of di vote and 30 out of France 81 seats for di European Parliament.

Dis cause President Emmanuel Macron to call quick parliamentary election, urge voters to reject “extremist fever”.

However, for di first ballot of di election on 30 June, National Rally perform even better, wit more dan 10 million pipo wey dey vote for am – one 33% share di vote.

Ms Le Pen tok afta di results: “Di Macronist bloc now all dey wiped out.”

She don run for di three presidential elections – twice against Emmanuel Macron, come second to am two times. She don become im greatest political rival.

National Rally dey position to win between 230 and 280 seats for di National Assembly, according to polling company Ipsos-Talan.

If di party win 289 seats, e go get one overall majority and di power to form di next goment. Oga Bardella tok say e go den try become prime minister.

People are also reading