Home Back

‘I make more money from podcast dan acting’

Informationng 2024/6/29
Taymesan

Ogbonge popular actor Temisan Emmanuel Ahwieh wey dey popularly known as Taymesan don tok how im journey for podcast dey pay off for di entertainment industry.

For di exclusive interview wit BBC News Pidgin, di ogbonge actor say im dey passionate about acting but di love for podcasting still dey.

Taymesan na ogbonge podcaster for Nigeria wia e dey host im program ‘Tea With Tay’.

Im podcast wey don bring celebrities to tok on issues. Celebrities like Falz, Davido, Yhemo Lee, Hilda Bacci, Ubi Franklin, Toke Makinwa and plenti odas don appear for di show.

Im be nollywood actor and television personality also wit plenti young followers for social media.

Na im play di role of ‘officer Okoro’ for inside di series ‘Visa on arrival’.

“Na influencer work I bin dey do bifor but me I get passion for Nollywood. From wetin I dey do, pipo come see say dis boy get talent. Na one of my friend bin first give me feem act”.

Taymesan say di money wey im dey make for podcasting dey give am joy sake of say na wetin im dey spend more time on.

Im add say podcasting dey draw am closer dan acting but passion dey keep am for di work.

“I dey make money from both podcast and acting. Di money wey I dey make for podcasting and nollywood dey combine to make me. Na passion dey make us do di work.”

“I dey do podcast everitime and di money dey come more becos I no dey act everitime. Podcast dey draw me come dia side and di frequency of money wey dey come from dia plenti pass Nollywood.”

While commenting on how Nollywood be at di moment, Taymesan say di industry don improve dan how e be bifor.

“So far, e don dey improve well. Na growing industry. and di ones wey we dey compare oursef wit don spend 100 of years. We dey pray say make di industry grow well.”

While speaking on di podcasting industry for Nigeria, di podcast star say di industry no easy but make more pipo dey enta am to create awareness.

“For di podcasting industry, you enta wit microphone and afta you do five episodes, nobodi go tell you to pack. E no easy, na serious work, but I really want make pipo come into di industry.”

Shot by: Monday Idara

Edited by: Mobolaji Olatunde

People are also reading