Home Back

South African President Cyril Ramaphosa swear in cabinet members

Informationng 2 days ago

Di President of South Africa, Cyril Ramaphosa, don swear in im deputy president and cabinet ministers wey go work wit am for di next five years.

Di swearing-in ceremony dey hold for di Cape Town International Convention Centre.

Dis dey come three days after Ramaphosa announce im cabinet members wey contain pipo from oda opposition parties sake of di power sharing agreement wey di African National Congress (ANC) bin get wit di oda parties as dem no fit win absolute majority for di general election.

Leading di line-up of pipo wey take di oath of office na di Deputy President Paul Mashatile, and di ceremony “dey expected to be presided over by Chief Justice Raymond Zondo or anoda judge wey di Chief Justice assign”, according to one statement on di South African goment website.

Dis go be di most ideologically diverse goment for South Africa history becos e contain pipo from across seven political parties.

“Dis men and women wey we appoint to di executive come from all corners of our kontri. Dem be reflection of di diversity of our nation. Dia responsibility na to work togeda to serve di people as a whole,” oga Ramaphosa bin tok on Sunday wen e dey announce di cabinet.

After Deputy President Mashatile don take im oath, di oda ministers den come up to di platform one by one to take dia own.

“I… solemnly affirm that I will be faithful to di Republic of South Africa, and will obey, respect and be faithful to di constitution and all oda law of di republic. And I undertake to hold my office as minister wit honour and dignity. To be a true and faithful councillor, not to divulge directly or indirectly, any secret matters that may be entrusted to me, and to perform the functions of my office conscientiously and to di best of my ability. So help me God.”

Di South African cabinet dey made up of 32 members, and di ANC make up 20 of dem or 62.5%, and dis include di office of deputy presidenty and some key ministries like foreign affairs, justice, finance, defense, and trade and industry.

Di opposition Democratic Alliance get 6 senior ministerial appointments and also some junior posts.

Oda smaller parties wey get ministerial posts include di Freedom Front Plus Party, di Inkatha Freedom Party (IFP), and di Patriotic Alliance party.

Jacob Zuma’s uMkhonto weSizwe (MK) party and di Economic Freedom Fighters (EFF), no gree join di coalition agreement wit di ANC and DA.

For one statement wey dem issue after di announcement of cabinet members, di EFF tok say di development don confirm “our longstanding view dat di GNU (Goment of National Unity) na nothing but a smokescreen for di ANC to secure a predetermined grand coalition wit di racist DA”.

We dey update dis tori.

People are also reading