Home Back

South Africa cabinet shake-up – Who dey in and who dey out

Informationng 2 days ago

South Africa President Cyril Ramaphosa don unveil one new coalition goment, afta im ruling African National Congress (ANC) party lost dia parliamentary majority elections for May.

E say “di government of national unity… dey happun for di first time for di history of our democracy”.

Di ANC now go get 20 out of 32 cabinet posts, while di Democratic Alliance (DA) – wey be di main opposition party until now – go hold six. Dem go share six oda portfolios among di smaller parties.

These appointments dey come afta weeks of tense negotiations wey bin threaten to scata di agreement – at one point Oga Ramaphosa bin accuse di DA say, dem dey try create “parallel government” wey dey against di constitution.

For di new cabinet, ANC go keep key ministries like defence, finance and foreign affairs.

Di DA portfolios go include home affairs and public works. Party leader John Steenhuisen go lead di agriculture ministry.

For inside one televised speech on Sunday, Oga Ramaphosa tok say: “Di incoming government go prioritise rapid, inclusive and sustainable economic growth and creation of a more just society.”

ANC Cabinet shake-up: Who remain; who comot and who dey demoted

Di shekele support di Africa National Congress bin receive during di elections show say di public don tire for dia poor record on delivering basic services and tackling unemployment, poverty and corruption.

Afta di ruling party lose di majority for di elections, dem bin dey forced to negotiate wit oda parties.

Di ANC new partners include di white-led Democratic Alliance – one pairing many pipo for South Africa bin consider unimaginable.

Di ANC under Nelson Mandela bin achieve dia aim of ending white-minority rule for South Africa for 1994.

Sake of di coalition, cabinet shake-ups dey expected.

Di cabinet members wey no dey come back na

  • Thandi Modise
  • Bheki Cele
  • Nalendi Pandor
  • Pravin Gordhan
  • Lindiwe Zulu

Demoted cabinet members:

  • Sihle Zikalala
  • Joe Phaahla
  • Mondi Gungubele

Promoted cabinet members:

  • Parks Tau
  • Sisisi Tolashe
  • Nomakhosazana Meth
  • Nobuhle Nkabane
  • Pemmy Majodina

Di ANC bin welcome di move as “important step forward, plus testament to di resilience of our democracy”.

Meanwhile, di DA say dem dey “proud to rise to di challenge and take our place, for di first time, for di seat of national government”.

Dem also promise “good governance, zero tolerance for corruption and pragmatic policy-making”.

Despite a coalition cabinet deal, stark political disagreements still dey between di ANC and di DA.

Perhaps di biggest and most contentious issues na DA opposition to di ANC national healthcare policy and to dia black economic empowerment programme.

Who be Nalendi Pandor: di long-time member of parliament wey dey affected

Dr Nalendi Pandor na South African politician, educator and academic.

President Cyril Ramaphosa bin appoint Madam Pandor as di Minister of International Relations and Cooperation for 2019.

Before then, she don serve under different administrations as Minister of Higher Education and Training from 2018 – 2019, Minister of Science and Technology from 2014 – 2018, Minister of Home Affairs (2012 – 2014), Minister of Science and Technology (2009 – 2012) and Minister of Education (2004 – 2009).

She be Member of Parliament since 1994.

Minister Pandor dey well educated. She get Phd from di University of Pretoria and honorary doctorates from di Cape Peninsula University of Technology, di University of Lisbon Portugal and di University College Dublin, Ireland.

Her daughter Aisha Pandor for one post for X bin react to di removal of her mama from di cabinet.

Aisha tok say her mama don serve as member of parliament since she be 9 year-old and finally she go take well-deserved time for rest.

“I dey happy for dis next stage for her life, wey I no say no go dey idle. I no say she go dey focussed on creating positive impact and she go continue to champion di causes of di underserved, voiceless and powerless.”

Thandi Modise

Dem appoint Ms Thandi Modise as di Minister of Defence and Military Veterans for 5 August 2021.

Before then, she bin serve as di Speaker of National Assembly of di Republic of South Africa from 22 May 2019 to 5 August 2021.

She bin serve as di chairperson of di National Council of Provinces (NCOP) during di fifth democratic Parliament. Currently, she be di Chancellor of di Cape Peninsula University of Technology.

Dem first elect Ms Modise to Parliament for 1994 and she serve as di chairperson of several parliamentary committees, like di Portfolio Committee on Defence, di Joint Standing Committee on Defence plus di Ad Hoc Committee for ratification of di Convention to Eliminate All Forms of Discrimination against Women.

She bin also serve as Speaker of di North West Provincial Legislature (from 2004 to 2009) and Premier of di North West (from 2010 to 2014).

She get long history of participation for di struggle for freedom from apartheid, starting wit di 1976 student uprising.

Ms Modise serve as a member of di ANC National Executive Committee. She also serve as Deputy President and Acting President of di ANC Women’s League. She also be di Deputy Secretary-General of di ANC from 2007 to 2012, among oda positions.

Ms Modise get degree for Industrial Psychology and Economics from Unisa. She also hod certificates for security.

Lindiwe Zulu

Ms Lindiwe Zulu bin serve as Minister of Social Development for South Africa.

She be member of di National Executive Committee (NEC) and chairperson for di African National Congress Subcommittee on International Relations.

Ms Zulu school for Swaziland, she join ANC afta di 1976 student uprising.

She hold plenty communication positions. For 1989, dem appoint her as Head of Communication for di ANC department of Religious Affairs.

For 2004, she become di South African Ambassador to Brazil. She dey elected to di ANC National Executive Committee first for 2007 and again for 2009.

Ms Zulu dey appointed special advisor to di President of South Africa on International Relations.

For 2014, dem appoint her as di Minister of Small Business Development.

In 2019, she dey appointed as di Minister of Social Development.

Mpho Parks Tau

Dem appoint Mpho Parks Tau as Deputy Minister of Cooperative Governance and Traditional Affairs on March 2023, e serve for dat position until June 2024.

Before e become member of Parliament, Tau be member of di Gauteng Provincial Legislature wia e bin serve for di Gauteng Executive Council as MEC for Economic Development from December 2020 to October 2022.

Before dat, e bin serve as di Deputy Minister of Cooperative Governance and Traditional Affairs between May 2019 and December 2020.

Joseph Phaahla

Dr Joseph Phaahla na ogbonge medical doctor and politician.

E get im Bachelor of Medicine and Bachelor of Surgery from di University of KwaZulu-Natal.

From im early days as medical practitioner to im tenure as Minister of Health for South Africa, Dr Phaahla journey show am as pesin wey get plenty experience and wey dedicated to public service.

As member of parliament since 2009, e continue to contribute im expertise and leadership to advance healthcare and governance for di kontri.

People are also reading