Home Back

Man dey police net afta community pipo find body parts of missing children for back of im house

ghanaweb.com 2 days ago

Angry residents burn di house of pesin wia dem suspect say im get hand for di death of  two pickins
Angry residents burn di house of pesin wia dem suspect say im get hand for di death of two pickins

Ghana police don arrest one suspect and im wife and don begin dey investigate afta community pipo find di bodies of two children for im back of im house.

Di community na Kakpayili for Tamale.

Residents dey allege say na di suspect dey responsible for di death of di children.

According to some of di residents, di bodies wey dem find inside one abandoned car behind di house of di man dem call Alhaji dey decompose.

One assembly man for di area Hafiz Andani tok say, di two pickins wey be three years old, miss last week Saturday.

Di Assembly man say di suspect deny say im know anytin about di pickins wey miss.

“Dis na afta we go di chief palace wey dem ask am wetin im sabi about dis mata. But pipo for di area vex wey di chief call police say make dem carry am go di police station.”

Police find body parts inside one car wey dem abandoned behind di suspect house.

Na so di residents wey already don vex, attack di house of di man wey dem burn am down.

Assembly man say, “we no care who di pesin be - weda im be opinion leader, political head or regular member for di community, wetin we want na justice,” E add.

Reports say eight pickins bin don miss bifor for di area, before di latest report of di two wey miss on 25 June.

According to di residents, dem neva gat any news from di police about dis pickins.

By Monday morning, di angry respondents storm di house of di suspect wia dem burn im house.

Police don arrest di suspect

Di suspect Alhaji, don dey di custody of di police as dem begin to dey investigate di mata.

Di police also grab di wife of di man,

Inside one statement, di police confam say dem find di body of di two children inside one abandoned car for one compound for di Kakpayili community.

“We don deposit di body of dis two children for di Tamale teaching hospital morgue say make dem do autopsy. Di hospital morgue also dey preserve dis bodies as di service dey continue di investigation,” di police statement conclude.

Some of di residents for Tamale say dem no wan make dis mata drag, dem say “we wan make di police finish di investigation fast and punish all di pipo wey gat hand for di death of our two pickins.”

People are also reading