Home Back

Police e-CMR and all documents wey all car owners suppose get for Nigeria

Informationng 2024/8/22
Man driving car

Car tiff-tiff na one of di problems wey most urban cities dey face for di world and di case of Nigeria no dey different.

To reduce di rate of how pipo dey tiff cars, motor and even motorcycles [okada], Police for Nigeria bin introduce di Electronic Central Motor Registration [ e-CMR] for 2023.

For di Nigeria Police CMR portal dem write say “One of di duties of di Nigeria Police Force na to protect di lives and property of all persons in Nigeria.

To carry out dis responsibility wit regards to motor vehicle security, di Police establish a Central Motor Registry (CMR) wia information of vehicles wey dey operate on Nigerian roads go dey.”

Police add say evri vehicle wey include cars, buses, trucks, motorcycles, di owner go need to register di motor vehicle for di registry wia dem go give am a Motor Vehicle Information Certificate.”

Di police bin announce say dem go start to enforcement di CMR on 29 July, 2024 and dem go begin sanction vehicle owners wey no get di e-CMR certificate to show say dem don comply wit di process.

But on Sunday 14 July, 2024 Police make U-turn on di enforcement date.

Why police do ‘about turn’ on e-CMR?

According to di Inspector-General of Police, IGP Kayode Adeolu Egbetokun, im order make dem match brake for di enforcement of di e-CMR wey suppose start on 29 July, 2024 sharp sharp.

Dis na to give pipo chance to know about di process and di benefits wey follow am.

For statement wey police tok-tok pesin Olumuyiwa Adejobi, bring out on Sunday 14 July, 2024, di IGP tok say

“We suspend am to give opportunity for mass enlightenment and education of all citizens and residents on di process, benefits and how effective e go dey to solve di challenge of vehicle related crimes, and protection of individual and corporate vehicle ownership.” im tok for statement.

How and wia to register for di e-CMR

To do di electronic Motor Registration Certificate no hard like dat, dis na di process you go follow to register your vehicle according to wetin Nigeria police put for di portal.

  • You go visit di police portal for di e-CMR online platform
  • You go create profile wit your Drivers licence, National Identity Number [NIN] or Tax Identification Number [TIN]
  • You go tok weda your car na personal or na company or organisation get am
  • You go fill your personal information and details.
  • You go select CMR request : under dis place you go also select CMR request and Sub request.
  • You go put your vehicle details and click next.
  • You go cross check if di vehicle details you put dey correct, if e correct den you go click proceed
  • You go view invoice and click Make payments snd choose any of di methods.
  • Dem go send details of your request to di phon number and email wey you use register.

Even though to pay money dey for one of di steps to register, for statement di IGP clear di air say di registration process no be to generate money.

“Furthermore, contrary to news wey dey fly upandan around di e-CMR, di Nigeria Police Force say di e-CMR no be revenue generating platform but na initiative to digitalize policing for effectiveness and general safety of lives and property of Nigeria residents

In light of dis, we seek di understanding and support of all well-meaning Nigerians and residents to key into di e-CMR system.”

Oga Egbetokoun also draw ear for all Police officers make dem stop to request for e-CMR certificates .

E add say anybodi wey dem catch say e dey use am to exploit members of di public wey no get di e-CMR certificates go chop punishment.

E say dem go get dedicated officers wey go do di but for now dem don suspend am till further notice.

Wetin be di benefits of e-CMR

According to di Nigeria Police, di e-CMR go provide firsthand database for di police go use fight vehicular crimes.

Im explain say wit dis database dedicated officers fit get access to real-time comprehensive data of evri vehicle on dia tablets.

E go also prevent multiple registration of vehicles and serve as a database to gada biometric and oda data of vehicle owners and individuals.

E explain say dis go add value to di national database and incident report portal wey oda Ministries, Departments and Agencies dey generate towards general security.

Di documents and oda tins FRSC dey check wen dem stop any vehicle

Vehicle registration papers : Dem go check if di car dey properly registered or if di registration don expire. Dem go also check Custom papers, purchasing receipt and invoice. Vehicle chasis number and colour.

Driver’s licence: Dis na for dem to make sure say you sabi drive and you get permission to drive any vehicle.

Caution sign [Triangle]: Dem go check if you get di reflective caution sign incase your vehicle break dem for road. So you fit use am notify oda drivers from far to avoid accident.

Tyres: Dem dey check if di tyres for di vehicle don expire or weda e dey road worthy.

Spare tyre: Dem go check if you get spare tyre and if di one you carry dey in good shape.

Wheel spanner and jack: E dey useful wen tyre puncture for road.

Brake light: Dis na to check weda di brake light dey work or not.

Wiper: during rainy season.

Fire extinguisher: No be to just carry fire extingusher keep inside your vehicle, if you open am to spray di colour wey e show go tell you weda e don expire or not. If e show red e don expire but if e show green e still dey good to use.

People are also reading