Home Back

Kenya president announce indefinite postponement of school resumption inside nationwide broadcast to address flood palava

Informationng 2024/5/18
Foto of Kenya president, William Ruto

Di president of Kenya Williams Ruto don announce further postponement of school children resumption for di kontri.

Di president tok dis for di national address wey im give for di state for di kontri capital, Nairobi.

According to President Ruto, schools for Kenya go dey closed till further notice.

“Di ministry of education dey directed to postpone di dates of reopening of all schools in di kontri for di second term until further notice”

Di Kenya ministry of education bin postpone di reopening of schools across di kontri due to di flooding.

Inside one statement for April, Cabinet Secretary of di ministry Ezekiel Machogu say dem go postpone di second term by one week due to di heavy rain, wey don affect some schools in di kontri.

Primary and secondary schools wey suppose open on Monday, 6 May 2024 don dey further postponed.

Oda tins President Ruto tok for di national address

Foto of flooded street for Kenya

President Ruto tok say di floods wey sweep through Kenya don claim about 210 life for di kontri.

“di weight of di tragic event wey happun in recent weeks don test di nation resilience for challenges. Persistent rain don cause devastating floods wey don claim 210 life as of today,” Ruto tok.

Di president tok how di flood don case serious wahala for di kontri.

“E don also cause injuries and cause katakata for our infrastructure and life of di pipo. No corner of di kontri escape, school resumption dey postponed and transportation don become challenges sake of di floods.”

How weeks of rain in Kenya don lead to deaths, floods plus affect school resumption

Rain don dey fall for di past six weeks for Nairobi, and di impact na ogbonge one.

So far, ova 180 pipo don die, sake of di heavy rains and floods.

Rivers and soakaways don overflow, roads don become waterways and homes don destroy.

Flooding for Nairobi dey unusual but how big dis year own dey don expose longer term problem wit di way di city don develop.

“You no fit contain nature. e no fit work like dat,” Prof Alfred Omenya, one urban planning and environment expert, tell di BBC.

E tok say plenti of di city sit down on top di Nairobi River floodplain, wey cut through di capital. Some oda rivers and streams also dey flow through Nairobi.

Properly developed drainage system fit cope, but as di city don grow ova di last century from 100,000 residents to today 4.5 million, di infrastructure neva keep up.

Compounding di problem na say less dan half of di residents dey connected to one sewage system. For slum areas, open sewers dey common, wey dey overflow wen e flood.

Slum settlements dem build on land wey dey prone to flooding
So far, ova 180 pipo don die sake of di heavy rains and floods
People are also reading