Home Back

‘Why di next project I go dey for gatz beta pass Seven Doors’ – Chioma Akpotha

Informationng 1 day ago

Ogbonge Nigerian actress Chioma Akpotha say wit Seven Doors Femi Adebayo don set di bar high and e mean say di next project she go dey for gatz be like dis series or beta pass am.

For exclusive interview wit BBC Pidgin, di actress tok about how di feem teach tolerance and also yarn about her favourite scenes for di series.

Chioma role for di series dey totori Nigerians wey believe say she finish work for dia.

She say wit Seven Doors Adebayo dey save souls.

Chioma say di message for di series don dey make pipo ask questions about dia history.

“And di tin sweet me for bodi, sweet me for belle, sweet me for chest, say ah, messages come out from dis project,” Chioma tok.

Filmed and edited by Mobolaji Olatunde

People are also reading