Home Back

South Africa president Cyril Ramaphosa ready to announce new cabinet executive - wen e go be?

BBC 2 days ago
Cyril Ramaphosa

Wia dis foto come from, Getty Images

New Informate 32 minutes wey don pass

Di President of South Africa Cyril Ramaphosa go announce di new national executive wey go form im second term administration dis evening.

Dis na afta di pipo of South Africa don wait anxiously to know who go dey President Ramaphosa cabinet despite di coalition wey happun bifor im inauguration for 19 June 2024.

South Africa parliament bin re-elect Ramaphosa as di kontri president for Friday 14 June 2024. Dis na afta one landmark coalition deal between di governing African National Congress (ANC) and opposition parties.

Di political parties bin form new goment of national unity wey consist of Ramaphosa ANC, di centre-right Democratic Alliance (DA) and smaller parties .

Ramaphosa suppose don announce dose wey go dey im cabinet, but gbege bin happun between di ANC and DA ontop di sharing of positions.

ANC bin get 40% of di vote, while di DA come second wit 22% and oda small parties follow.

Wen president Ramaphosa go announce cabinet

Cyril Ramaphosa

Wia dis foto come from, Getty Images

According to di South Africa presidency, di list of di new executives for di kontri go dey announced on Sunday evening 30 June 2024.

"Di announcement go dey in form of televised address to di nation. Di new national executive go constitute di 7th Democratic Administration as Goment of National Unity wey include different political parties as outcome of di national and provincial elections wey hold on Wednesday, 29 May 2024,"di presidency tok on Sundy afternoon for dia X page.

President Ramaphosa go allocate cabinet positions wey go include members of di DA and odas wey join body form di coalition.

Di main negotiations wey delay di announcement na sake of di matter between ANC and DA wey concern di sharing of power.

Tori be say di Democratic Alliance dey demand ogbonge position wey get influence for di new goment. And some of di positions include deputy presidency and plenti ministerial positions.

How di mata take waka be say, since ANC party no manage to pass di 50% mark for di votes, dem gatz to gree on a coalition wit anoda party or parties for di first time to co-govern di kontri and re-elect Ramaphosa for second term.

Wia dis foto come from, x/SABCNews/@lebotshangela

Cyril Ramaphosa and im wife
Wetin we call dis foto, Cyril Ramaphosa take oath of office as South Africa president

Who dey expected to dey Ramaphosa cabinet

Di parties wey dey expected to form di South Africa cabinet include:

  • Democratic Alliance (DA) wey win di second most votes wit 21.8%
  • uMkhonto weSizwe (MK) party wey get 15% of di votes.
  • Economic Freedom Fighters (EFF) wey get 9% votes

Oda parties like IFP, Patriotic Alliance (PA) and some oda smaller ones wey support di nomination of Ramaphosa as president go expect make di president reward dia parties wit appointments.

People are also reading