Home Back

Couple mark 50 years of marriage for di 'divorce capital' of Nigeria

BBC 2024/10/5
Mahmud Kabir Yusuf and Rabiatu Tahir

Wia dis foto come from, Mahmud Yakasai

  • Author, Mansur Abubakar
  • Role, BBC News, Kano

One couple wey dey stay for Nigeria "divorce capital" don collect ogbonge gbosa afta dem celebrate dia 50 wedding anniversary.

Mahmud Kabir Yusuf and Rabiatu Tahir tell BBC about di secrets to dia happiness and about why plenti marriages no dey work for di northern city for Kano, for video wey don go viral.

Oga Yusuf say na becos im wife dey generous nature.

Di 76 year old tell BBC Hausa say, "She be very in selfish pesin and don ova look plenti tins wey don contribute to di success of our marriage."

E make Ms Tahir wey dey her late sixties to smile. Togeda dem get 13 pikin and she hail her husband say e dey keep calm wen di wahala wey all families dey face come.

She say, "e be very patient man and I feel like na di key to our success be dat."

Di two say dem love and respect each oda and dem clearly like to dey spend time togeda as dem just dey laugh for di interview.

For Hassana Mahmud, na revelation. Di 39 year old divorcee don marry five times and and dey impressed by di couple and dia contentment.

"For all my marriages, na only four years I don spend wit my spouse - so to see dem for social media dey celebrate dis kain tin dey refreshing," na wetin she tok.

"My husbands bin dey nice and caring during courtship but change afta wedding," na so di mama of four tok.

She add say, "I feel bad wen pipo call Kano di 'divorce capital of Nigeria', I hope tins go change."

Kano get di nickname afta divorce rates start to dey rise for di 1990s and since den e neva fit fit comot di name.

Hundreds of marriages dey break up each month for di most populous state for Nigeria. Dia capital Kano city na di commercial centre for di north.

For one 2022 research wey BBC collabo wit di local goment to do, dem find out say 32% of marriages for Kano state dey last just between three to six months.

E also show say some pipo wey dey between 20 and 25 don run like three marriages.

Wia dis foto come from, Getty Images

Kano mass wedding
Wetin we call dis foto, Brides and grooms dey come for mass wedding for Kano central mosque for 2023

Di scale of separations dey worry Hisbah, one Kano state funded Islamic agency wey dey deal wit moral issues and enforce Sharia law for di state.

E get police unit wey dey enforce tins like segregation for public and alcohol ban for Muslims wey be most of di pipo wey dey live for di state. Dem also get counselling service mainly for struggling married couples.

Long lines of women dey normally full di office, wey wan complain say dia ex-husbands no dey help wit dia pikin.

Pipo dey normally marry young for Kano mostly bifor dem reach 18 sef.

Odas feel say Islam easy way of divorce fit be di cause wia husband fit tell dia wives “I divorce you” or write am for paper and marriage don finish. Nowadays na social media dem dey take end marriage.

Aminu Daurawa dey work for Hisbah to address di high divorce rate. One of di solution na to offer pipo second chance to pipo and prepare dem well for married life.

Di agency dey arrange mass weddings wey dem dey call “Auren Zawarawa” mostly for divorced pipo wey dem go run am as matchmakers.

Di hundreds of newlywed couples wey dey do big wedding go collect small money to help dem run business and oda household tins.

Dis kain parole start for 2012 even though oga Daurawa still know say di divorce rates still dey high.

E say, “we sabi di problem, na why we set up committee wey go check on di couple afta di marriage so we no go get di results wey we bin dey get bifor.”

Wia dis foto come from, AFP

Mass wedding
Wetin we call dis foto, Kano mass weddings couples dey collect household items to help dem start di marriage

But Hadiza Ado, wey be di founder of di non-governmental organisation Women and Children Initiative, say di number of divorce still dey increase.

She tell BBC say, “As at now we dey get up to 30 marital cases for our several offices everi day.”

“As at now na di wahala wit Nigeria economy be di number one reason.

“Husbands go go work to make ends meet but come back without shi-shi and e dey cause wahala.”

Di practice of matchmakers dey common for Kano sake of sat for Muslim society single pipo no dey mix, so e dey make am hard to meet potential partners.

Di only place wey di sexes dey mix na for university and oda higher education wey most pipo no dey go.

Wen pipo match, dem dey normally marry bifor dem sabi demselves wella.

Infact, na so Mahmud Kabir Yusuf and Rabiatu Tahir meet wen dem dey younger, by one older woman for dia yard.

Na she see dem say dem go match each oda well but no be until anoda 12 years, bifor dem marry so dem sabi each oda wella.

Matchmaker Rabiu Ado
Wetin we call dis foto, Matchmaker Rabiu Ado (R) nickname na "Mai Dalili", meaning "He who makes it happen"

One man wey get rep say e dey make successful matches say na di koko be dat.

Rabiu Ado tell BBC say, “plenti investigation need to dey done bifor marriage so dem go sabi demselves”

E don be matchmaker for 10 years. Di 46 year old sat no be wetin e bin wan do even though n aim mama work.

E bin dey work as truck driver wen im friends come meet am say dem no fit find wife.

Afta e make some successful introduction, e find out say di family business dey im bodi.

E now get billboards wey dey advertise im business and e dey get frm one to five customers everi day. E go interview dem to sabi dia attitudes and wetin dem dey fid. Mostly men want women wey fit make money and women want rich men.

“Plenti pipo dey enta marriage wit wrong mindset and na why dem dey disappointed afta sometime.”

E say e don arrange like 500 marriages for di last deade an get success rate of ova 90%.

E dey tell couples say make make dem always take time to sabi each oda well bifor dem marry.

Oga Ado wey pipo dey call "Mai Dalili" meaning "He who makes it happen" say di high number of divorce mean say some pipo no dey take marriage serious.

“I feel say why divorce high for Kano be say pipo dey always reason say I fit find anoda pesin afta divorce.”

Wia dis foto come from, Mahmud Kabir Yusuf

Mahmud Kabir Yusuf and Rabiatu Tahir
Wetin we call dis foto, Mahmud Kabir Yusuf and Rabiatu Tahir bin sabi demselves for 12 years bifor dem marry.

Islamic cleric Abdullahi Ishaq Garangamawa defend how easy e dey for Muslims to divorce.

E tell BBC say, “Islam dey merciful and dey make marriages and divorce to no dey jard so pipo no go dey caged wen tins no dey work well.“

E add say, “bifor, we no get dis many divorces as our parents own wey dey last long. But na recently pipo don dey abuse di process for selfish interests.

“But, unlike oda religions wey be we die dia no mata wetin happun, Islam dey legalize divroce wen tins don rough wella.”

Oga Yusuf wey bin dey work for di now closed Nigeria Airways say sharing life wahala and helping one anoda na di koko to why im don get long relationship wit Ms Tahir.

“Love also be koko, bicos wen you live yourself true-true, you go tend to stay togeda.

My advise to to pipo wey wan marry na say, make dem no do am for selfish reasons but enta am wit true intentions.”

Im wife gree and add say, “my own advice for pipo wey wan marry na say make dem dey patient wit demselves – if one partner dey vex, make di oda one dey calm.”

Additional reporting by Abba Awwalu

People are also reading