Home Back

Southgate changes fail to improve England wey make Slovania enta R16 as best loser

Informationng 4 days ago
Bellingham

England dey disappointed wit dia performance against Slovenia as dem bin dey expect a win – but dem no get any goal.

Such an impressive game from Slovenia to hold England to a goalless draw even though na dem dey top di Group C table.

England coach Gareth Southgate fit dey expect better score from di players but e no get am despite making changes wey im hope say go turn di game around

Denmark and Serbia also play goalless draw. By dat, Serbia don comot and Denamrk go make am out of di group stage.

England dey go through as group winners while Denmark finish second wit Slovenia third – both sides go through to next stage of di competition.

Slovenia advance to di knockout stage for di first time and e show for dia celebration- as well as Denmark

Di two teams finish level on points, goal difference, goals scored and disciplinary record (6-6 on yellow cards).

Cole Palmer make im first appearance for di Euro 2024 at 70th minute afta replacing Saka.

Saka dey very instrumental to di England team afta playing from both forward and middle. Im only goal in di match dey cancelled sake of offside position.

Janza hold di Slovenia defence very well wit different clear out wey save di team wit goalkeeper Oblak saving so many balls from going into di net.

Sesko give England defenders tough time but im no get chance convert any of di ball into goal.

As Mainoo enta game, evritin change for England as dem hope for a goal but still no chance behind di net.

Slovenia dey happy to go to last-16 as one of di best third-placed finishers.

Slovania celebrate draw against England
Slovania celebrate draw against England

FULL-TIME: England 0-0 Slovenia

90+2mins- Alexander Arnold try a long shot for England but it was far wide on di post

‘CHANCE LOST

90mins- Good move by Mainoo, nice touch by Kane… Oh, good assist, Palmerrrrr. Oh no, Palmer no score di goal as e play straight to di goalkeeper hand

England 0-0 Slovenia

FOUR Minutess ADDED TIME

89′ SUBSTITUTION– Foden out and Gordon in for England.

Janza out and Balkovec in for Sloveia

Can dis make it a lead? Oh No, e no go through. Foden shot blocked by defenders

87′ FREE KICK for England as Palmer goes down. Foden to take di kick

86mins- Risky pass for England as Iličić snatch di ball. Ball back in play for England wit Foden and Walker creating middle chances

85′ SUBSTITUTION– Sporar and Mlakar out- Celar and Stankovic in for Slovenia

83′ SUBSTITUTION- Trippier out for Alexander-Arnold. England wan play wit force since Sesko wey be threat don comot

82mins- Foden looking for a long shot attempt, but blocked by defenders

81mins- Janza goes down from tackle from Bellingham

80mins- Oblak and Janza trying dia best fro Slovenia at di middle but goal still neva show

79′ YELLOW CARD for Phil Foden. Im no dey happy but na im head sabi shaa

CORNER for England from Foden- but Kane go push pesin for inside di box and it is a foul for Slovenia

77minsSlovenia dey play wit cool to keep dia post safe

75′ SUBSTITUTION– Sesko out and Iličić in for Slovenia

What a SHOT by Declan Rice!!!! But it was wide and e no reach do goalpost.

Palmer gets his first ball, running into a safe area

Not so good a free kick for England.

73′ FREE KICK for England to be taken by Foden. Can he make it a lead?

YELLOW CARD– Bijol got booked for foul against Kane

England 0-0 Slovenia

70′ SUBSTITUTION- Saka out, Cole Palmer in

What a wasted free kick

FREE KICK for Slovenia. Only a long shot fit make am happun from 29 metres distance

68‘ YELLOW CARD for Guehi

62mins- Walker pressing in from di back, playing wit Saka

60mins- England really pushing wit impressive play from Mainoo and Foden. Foden ready to shoot but di defender push di ball comot for im leg

59mins- Foden playing wit Mainoo trying to get into di Slovenia post.

57mins- Dat for be a goal for England, but Saka still no touch di ball well afta Mainoo give am a header

CORNER for Engalnd

56mins- Foden steps forward to take di kick. Long shot to di box 18, Saka head no too touch am

FREE KICK for England

54mins- Serious pressure by Rice and Bellingham moving into Slovenia side

52mins- What a miss from Bellingham afta a poor touch leading to gaol kick. Long pass from Kane.

50mins- CORNER for England. Oh, shot by Foden goes into goal kick

48mins- Saka playing wit Rice to create chances from di far back as dem advance to Slovenia side

SUB- Mainoo enta to play for England

46mins- Foden playing from di side of di box 18

England 0-0 Slovenia

SECOND HALF

England on di move

England 0-0 Slovenia

HALF-TIME

45mins- Di two teams dey play goalless draw for di first half and nothing to seperate dem yet.

44mins- Rice cross to Walker back to Saka- ball in play from di middle as England kontinue to dominate from di side

42minsSaka leading from di top right hand. Long shot from Harry Kane deflected. CORNER for England

40minsKane!!!- Dat was very close for Kane to put England in di lead but im no touch di ball as di last man for Slovenia goalpost. Gallagher also miss di header

England 0-0 Slovenia

38mins- Foden wit a long drive. Long shot for Bellingham but e no fit touc am.

Karnicnik play good cross but it was cleared comot from di England goalpost

Elsnik playing from di middle for Slovenia

36mins- Sesko and Elsnik creating chances for Slovenia inside England box 18- but di chance neva convert to goal

34mins- Foden stretch from 29 metres distance wit a long shot straight into di hand of di goalkeeper Oblak

Saka goes down froma a foul. FREE KICK for England

32mins- Foden dey try find chance but e neva come and Slovenia no wan gree for dis match

31mins- Sporar put pressure on Gallagher- greta run wit a shot but Pickford catch di ball wit ease

29minsKane get a header but not successful, foden fight for di ball inside box 18, give Kane- Kane wit a shot but Oblak catch am for Slovenia

CORNER for England

Pickford save one long ball.

28mins- Dangerous time for Slovenia as England put more pressure for dia goalpost

Trippier creating a wide chance at di midfield trying to call out di Slovenia players. Rice and Walker playing from di right hand

26mins- Good run for Foden wit a pass for Kane but e no fit run follow di ball sake of di speed of di ball

25mins- Harry Kane trying to make run towards di Slovenia goalpost but Drkusic and Bijol dey block am

24mins- Foden trying to break through di Slovenia defence. Good pass from Walker to Saka but e lose di ball to Sesko

England 0-0 Slovenia

22mins- YELLOW CARD for Erik Janza Slovenia player sake of foul against Saka

20mins- Mlakar and Sporar dey try create magic for Slovenia but e neva show

19mins- GOOALLL CANCELLED. A goal by Saka dey cancelled sake of offside position

FREE KICK for Slovenia

17′ YELLOW CARD– Trippier bag a yellow card for im foul

16mins- Good run by Saka from di side of di line but im crossing too much for Foden to reach

14mins- Throw-in for Slovenia. A long throw. A fine crossing for Slovenia, Sporar tried a header but di head no touch am

12mins- Good dribble by Gallagher on di side of di line for England

10mins- Sporar moving di ball into England box 18, but dem no fit convert di chance as Stones and Walker hold di defence

9mins- Good run from Phil Foden into di box 18, good cross to Saka, oh, Saka no fit reach di ball. Great run dia by Foden, but im lose di ball on di run

8mins- Janza try clearing ball from di middle as di England players keep putting di pressure. Declan Rice also playing wit kane as dey keep di ball in play for front of Slovenia goalpost

6mins- Bellingham and Saka playing from di side. England get a throw-in, as Saka keep di ball in play

4mins- Oh great run by Slovenia, Sesko touch di ball wit a header but oh no, England keeper catch am. Pickford confidently catch di ball

3mins- Di pressure dey on for England to deliver

1mins- Declan rice wit di ball trying to creat some great possession

0mins- Di match don KICK-OFF

Di teams don dey field dey sing dia national anthem. Dis game dey expected to dey tough as both team go struggle to take a win.

Welcome to di live commentary of England vs Slovenia

Harry Kane scored im first goal of di tournament  against Denmark

England and Slovenia squad

Who England fit face for R16?

Starting eleven: Pickford, Walker, Rice, Stones, Guéhi, Saka, Kane (C), Bellingham, Foden, Trippier, Gallagher.

SUB: 3 Shaw, 8 Alexander-Arnold, 13 Ramsdale (GK),14 Konsa, 15 Dunk, 17 Toney, 18 Gordon, 19 Watkins, 20 Bowen, 21 Eze, 22 Gomez, 23 Henderson (GK), 24 Palmer, 25 Wharton, 26 Mainoo.

Slovenia Squad

Starting eleven: Oblak, Karnicnik, Drkusic, Bijol, Janza, Stojanovic, Gnezda Cerin, Elsnik, Mlakar, Sporar, Sesko

SUB: Belec (GK), Vekić (GK), Balkovec, Blažič, G. Stanković, Verbič, Lovrić, Kurtić, Horvat, Vipotnik, Celar, Brekalo, Žugelj, Zeljković, Iličić.

People are also reading